Independence?...Whatever


...Refusing To Pretend.


Uploaded by TeachingHeads

COLO-MENTALITY [Colonial Mentality]
By Fela Kuti

Colo-mentality

E be say you be colonial man
You done be slaveman before
Dem done release you now
But you never release yourself

I say you fit never release yourself
Colo-mentality

E be say you be colonial man
You done be slaves from before
Dem done release you now
But you never release yourself

E be so, e be so
Dem dey do, dem dey overdo
All the things say dem dey do [E be so!]
E be so
Dem dey do, dem dey do, dem dey overdo
All the things say dem dey do [E be so!]

E be so,
Dem dey do, dem dey think say dem better pass dem brother.
No be so? [E be so!]
E be so
Dem dey do, dem dey think say dem better pass dem brother.
No be so? [E be so!]

The thing wey black no good
Na foreign things dem dey like
No be so? [E be so!]
The thing wey black no good
Na foreign things dem dey like
No be so? [E be so!]

Dem go turn air condition
And close them country away
No be so? [E be so!]
Dem go turn air condition
And close them country away
No be so? [E be so!]

Dem Judge him go put white wig
And jail him brother away
No be so? [E be so!]
Dem Judge him go put wig
And jail him brother away
No be so? [E be so!]

Dem go proud of dem name
And put dem slave names for head
No be so? [E be so!]
Dem go proud of dem name
And put dem slave names for head
No be so? [E be so!]

Colo-mentality, now make you hear me now!

[Colo-mentality Colo-mentality]
Mr. Ransome, we make you hear [Colo-mentality]
Mr. Williams, we make you hear [Colo-mentality]
Mr. Allia, we make you hear [Colo-mentality]
Mr. Mohammed, we make you hear [Colo-mentality]
Mr. Anglican, we make you hear [Colo-mentality]
Mr. Bishop, we make you hear [Colo-mentality]
Mr. Catholic, we make you hear [Colo-mentality]
Mr. Muslim, we make you hear [Colo-mentality]
Na Africa we dey go make you hear [Colo-mentality]
Na Africa we dey go make you hear [Colo-mentality]
Colo-mentality hear [Colo-mentality]
Colo-mentality hear [Colo-mentality]
Mr. Ransome, we make you hear [Colo-mentality]
Mr. Ransome, we make you hear [Colo-mentality]
Na Africa we dey go make you hear [Colo-mentality]
Na Africa we dey go make you hear [Colo-mentality]
Colo-mentality hear [Colo-mentality]
Colo-mentality hear [Colo-mentality]
[Colo-mentality]
[Colo-mentality]
[Colo-mentality....]

..............................................................................................................................





A Note From The Gull

Thank you, Fela Kuti!

"Patria est communis omnium parens" - Our native land is the common parent of us all. Keep it beautiful, make it even more so.

Blessed is all of creation
Blessed be my beautiful people
Blessed be the day of our awakening
Blessed is my country
Blessed are her patient hills.

Mweh ka allay!
Guanaguanare

0 comments: